Burial of actor Sisi Quadri happun wit tears and sorrow as Nollywood celebrities mourn am

Collage foto of Sisi Quadri

Wia dis foto come from, Instagram/SisiQuadri/Anikulapo

Wetin we call dis foto, Sisi Quadri

Plenti celebrities for di movie industry bin come out in numbers to pay dia last respect to Tolani Quadri Oyebamiji aka Sisi Quadri.

Diz celebrities bin dey in shock following di news of di sudden death of dia colleague wey dem dey always join body act movies togeda.

Sisi Quadri dey well-known for im comic style of acting in movies esepcially for di Yoruba industry.

Many of di stars for di industry describe Sisi Quadri as humble pesin and e no get wahala.

Sisi Quadri dey popular among im movie colleagues
Wetin we call dis foto, Many popular movie star cry for di burial of Sisi Quadri

'im bin collapse for stage before'- Brother

One of di brothers of late Sisi Quadri, Oyebamiji Muktar, tok how di deceased bin waka before im death.

Di brother tok say dem first call dem one day say Sisi Quadri bin collapse for stage wia e dey perform and di oda brother go carry am.

"We carry am go hospital, dem treat am for dia before dem tok say im get malaria-fever and dem treat am.”

Apart from di fever, di younger brother tok say Sisi Quadri bin also get stomach ulcers and dem dey treat am.

Muktar add say, di late actor no dey too sleep and sometimes dem get to switch im phone off so dat dey dem no go call am for work.

"Im waka wit im leg for di hospital and di sickness wey do am no be di one wey make am dey bed-ridden."

Di death of di comic actor still dey surprising to many as di release of Anikulapo movie wey im act just begin trend.

Sisi Quadri dey very popular for im comic character wey dey mixed wit heavy and localised mimicking and jesting.

Di news of Sisi Quadri bin begin trend on Friday 1 March 2024 afta which Nollywood actors and actresses begin dey confam di death.

Di Chairman of di Theatre Arts and Movie Practitioners Association of Nigeria (TAMPAN), Bolaji Amusan, wey dem dey popularly call Mr Latin, confam di death of Sisi Quadri on Friday.

Anoda colleague, popularly called ‘Jigan Baba Oja’ wey also dey popular for di Yoruba movie industry, also confam di death of Sisi Quadri for im Instagram page.

“E dey sad to say goodbye! Quadri ! May di lord grant you peace R.I.P,” Jigan tok for im Instagram page.

Sisi Quadri na from Osun state

Wia dis foto come from, Instagram/SisiQuadri

Wetin we call dis foto, Sisi Qudria celebrate im 44th birthday last year

Sisi Quadri wey be indigene of Iwo town for Osun state bin celebrate im 44th birthday for 25 December 2023.

Aside di fans wey dey enjoy watch as e character dey abuse oda pipo, some legends don also tok good about im role for di movie industry.

Among di famous Nollywood celebrities wey don send condolences give di deceased na Biola Bayo, Ibrahim Yekini, Odunlade Adekola, Mr Latin, Ibrahim Chatta, Regina Chukwu, and many more.

Regina Chuckwu even write say she still follow Sisi Quadri tok few days ago but no know say im go die very soon.

She say she bin even work wit Sisi Quadri well and im death really pain her.

Sisi Quadri na actor for inside Anikulapo

Wia dis foto come from, Instagram/KunleAfolayan

Wetin we call dis foto, Sisi Quadri wit Kunle Afolayan for di set of di popular Anikulapo movie

Tori say Sisi Quadri bin dey sick before and dem carry am go Ladoke Akintola university hospital wia im bin dey receive treatment.

One of Sisi Quadri friend Otunba Adekunle Abolade wey dey known as Dodo Ede tok say di late actor bin dey sick but im neva fit tok di cause of im death.

Na Ogbomosho di late actor bin die afta wetin dem still call brief illness but no concrete cause yet.

“Im body don dey deposited for di morgue wia we go know di next tin do,” im colleague tok.

One trending video show how di late Sisi Quadri dey complain about im health. E dey also complain say dem no reveal di outcome of di test wey dem do for am for di hospital.

“Dey no fit take me serious,” na part of wetin di late actor tok for di video as e mention say hand dey pain am so im no fit drive but pesin carry am reach di hospital wia im complain.

Early Saturday morning, plenti crowd gather for di house of di late Sisi Quadri as dem dey sympathise with im family. Plenti pipo bin dey sad and many of dem dey cry.

Di body of di late actor don reach im hometown wia dem go perform burial rites for am.

Sisi Quadri na one of di ogbonge actors wey dey inside di popular Anikulapo moview series wey just comot.

For di movie, Sisi Quadri bin act wit Layi as ghost wey dey try protect Saro (lead character for di movie)

Sisi Quadri picture for im house
Crowd for Sisi Quadri house
Wetin we call dis foto, Plenti crowd gather to pay dia respect to Sisi Quadri